Tuesday, August 18, 2009

NO MIND THEM

Wonder darkness.
Utter madness.
Incurable blindness.
Lost souls. Groping in caves.

Man dig pit for man. Man shit with his mouth.
Mix am with cow dung
And cover man with the shit.
e dey cry say
Make master wipe shit smell comot for im bodi.

Blind eyes. In blazing noon light see blinding darkness.

This utter madness
dey make me wonder for this darkness
that has taken us prisoners

Man steal man land. Man give man stone chop.
e cry say make master throw manna come.

Penury in Greenland.

Animal na food for man. Before.

See these yeye children
Who pour blood inside water call am wine…
Master no mind them.


…even Saint Hitler dey beg master
say make e touch the world for heart

Bedel Bokassa sef dey beg for calmness
e wan sleep for paradise where war has no bed

This incurable blindness
wey plenty darkness bring…

When you go for patrol
To see your magnificently made earth
Master abeg no cry
If you have to be guarded in an armored car

Soja man go dey for Cathedral
lest they highjack the sacrament

Man put bomb inside man soup pot.
Man life scatter like shit inside rain.
See mumu still dey cry
Say make master come quench fire for Gaza…

Master…
Master.
Master!
You see these yeye children
No mind them jo.

No comments:

Post a Comment